Policeman: (Shaking) Ah! You carry dog?
Me: (I bone face) Yes, I carry dog. Dat one na offense?
Policeman: (Feeling uncomfortable) Na where una dey come from?
Me: From hospital.
Policeman: Ehen! you sick?
Me: No, na person wey the dog bite we go see. The personal most die sef.
Policeman: (Terribly shaken by now) Ehen! But why the dog dey shake head like that?
Me: Na so im dey do if e wan bite person.
Policeman: The dog know you?
Me: Yes nah, no be my dog?
Policeman: (Sweating) This your door, how you dey open am?
Me: How you take enter?
Policeman: Abeg! Na since I dey try open am, but e no open. (The dog was now getting impatient and gave a small growl, its tongue almost touching the policeman's left ear).
Policeman: (Now sliding forward) Oga, I take God beg you, open the door for me make I comot. I no go collect anything from you.
Me: How much you go pay me?
Policeman: Ah! I neva hustle anything since morning. Na only N1,000 dey with me.
Me: You neva ready. (I looked back at the dog).
Policeman: Ok ok ok ok ok, e reach N2,000. The oda N1,000 na my wife own, but I go give you join.(Now, close to tears as the dog was becoming really impatient) Oga, I be......g, Oga, sorry. Take the N2,000 make you open the door plssssssse!
Me: Oya, bring am. (I collected the N2,000 & allowed him out of the car)
Policeman: God punish you. Idiot, e no go ever better for you and your yeye dog. Wicked man!!! It'sWl Ooo
No comments:
Post a Comment